13 – Kemi dey go on date wit Somto 👨🏽‍🤝‍👩🏾

Kemi dey for restaurant.

She get date wit Somto.

Kemi no sabi Somto.

But na padi of anoda padi.

Somto reach der on time.

E talk “Hello!” and Kemi talk “Hi!”.

Somto siddon, and Kemi look am.

She reason sey e too fine.

Kemi smile, and Somto dey look am.

“Yu get nice smile”, Somto kon talk.

Na di same story for different way be dis:

I dey restaurant.

I get date wit Somto.

I no sabi Somto.

But na padi of anoda padi.

E reach der on time.

E talk “Hello!” and I talk “Hi!”.

E siddon and I dey look am.

I reason sey e too fine.

I smile, and Somto dey look me.

“Yu get nice smile”, Somto kon talk.

Questions:

  • Shey Kemi dey house?

No, Kemi no dey house.

She dey restaurant.

  • Shey Kemi get date wit Gbolahan?

No, Kemi no get date wit Gbolahan.

She get date wit Somto.

  • Shey Kemi sabi Somto?

No, Kemi no sabi Somto, but na padi of anoda padi.

  • Shey Somto reach di restaurant on time?

Yes, Somto reach di restaurant on time.

  • Shey Somto talk “Hello?”

Yes, Somto talk Hello to Kemi.

  • Shey Kemi reason sey Somto dey fine?

Yes, Kemi reason sey Somto too fine.

  • Shey Somto dey look Kemi?

Yes, Somto dey look Kemi.

  • Shey Somto talk sey e like Kemi smile?

Yes, Somto talk sey she get nice smile.

Start the discussion at community.naija.guru

Scroll to Top