56 – Mariam make business decision 👩🏽‍💼

Mariam na oga of marketing for one manufacturing company.

She déy convinced sey now na di best time for ha company to expand gó obodoyinbo since demand dey grow for di company products for foreign markets.

No be only sey exports dey grow, but very good part suppliers déy for some places for obodoyinbo.

So to expand gó obodoyinbo go increase market share and reduce cost too.

Any move to gó obodoyinbo go require careful planning.

Since conditions for all di obodoyinbo déy different, she go need find people wey sabi dat thing well-well to help am.

Mariam don visit most of di important markets for obodoyinbo.

She no want mess up, so she decide to ask ha customers wey she get before for obodoyinbo for advice.

E go take time for am to do di necessary research to make sure sey di expansion plan déy successful.

Na di same story for anoda way be dis:

I be oga of marketing for one manufacturing company.

I déy convinced sey na time for awa company to expand gó obodoyinbo since demand dey grow for awa products for obodoyinbo market.

No be only sey exports dey grow, but very good parts suppliers déy for some places for obodoyinbo.

So to expand gó obodoyinbo go increase market share and reduce cost too.

Any move to gó obodoyinbo go require careful planning.

Since conditions for all di obodoyinbo déy different, I sabi sey I go need find people wey sabi dat thing well-well to help me.

I don visit most of di important markets for obodoyinbo.

I no want mess up, so I decide to ask my customers wey I don get before for obodoyinbo for advice.

E go take time for me to do di necessary research to make sure sey di expansion plan déy successful.

Questions:

  • Wetin be Mariam work?

Mariam work na oga of marketing for one manufacturing company.

  • Wetin Mariam déy convinced about?

She déy convinced sey now na di best time for ha company to expand gó obodoyinbo.

  • Wer very good parts suppliers déy?

Very good parts suppliers déy some places for obodoyinbo.

  • Wetin expanding to gó obodoyinbo go do?

To expand gó obodoyinbo go increase market share and reduce cost too.

  • Hu I sabi wer I fit find hu go fit help me?

Yu sabi sey yu go need find people with local expertise.

  • Shey I don visit all di important obodoyinbo markets?

No, yu don visit most of di obodoyinbo market.

  • Wetin I ask my customers for obodoyinbo wey I don get before?

Yu ask dem for advice.

  • Shey e go take me short time to do di necessary research?

No, e go take yu long while to do di research.

Start the discussion at community.naija.guru

Scroll to Top