59 – Machi like to read 📖

Machi been dey read only paper books.

For long time, di idea of electronic book no even exist.

All reading material na for paper dem print am.

But now, plenty ways dey to read.

Recently, more and more pipu don start to dey read book for dia mobile devices.

Pipu fit read for dia phone, dia tablet, or for e-book readers like Kindle if dem want.

Machi prefer say e easy pass to read for mobile device becos she always get am wit ha.

She think say dem dey handy wen she dey travel since to dey carry book for ha box fit dey inconvenient.

She fit also order any book wey she want sharp-sharp wit internet.

Her husband Goke prefer to hold normal book for hand.

He tink say e dey more comfortable and na better reading experience.

Goke also like to dey spend time for book store and library, make e just see di books wey dey available.

Goke dey too buy books, but Machi just dey make note of books wey she like so she go fit order the e-book version online, make she read am for her portable device.

Na di same tori for anoda way be dis:

For long time, na only paper books I dey read.

For most of my life, di idea of electronic book no even exist.

All reading material, na for paper dem print am.

But now, plenti ways dey to read.

I notice say plenti pipu start to dey read book for mobile device.

I see pipu dey read for dia phone, tablets and oda e-book reader wey dey lie Kindle.

I need talk say I don prefer di convenience say I fit read for mobile device becuase I fit always get my book wit me.

I don see say e-book dey very handy wen persin dey travel since to dey carry book for box fit dey inconvenient.

Again, I fit order any book wey I want whenever I want am wit internet.

My husband Goke prefer to dey hold book for hand read.

He talk say e dey more comfortable and say na better reading experience.

Na just olden days style be dat for my mind.

Goke dey spend long for bookshop and library, make e see di kain books wey dem get.

E fir buy book after e check finish.

Me I prefer make I just write di name of di book wey I like.

Den I go just order di book online, read am for my device.

Dat one better!

Questions:

  • Which idea no exist for most of her life?

Di idea of electronic book no exist for most of her life.

  • When pipu start to dey read book for mobile device?

Pipu start to dey read book for mobile device for recent years.

  • Wen Macho dey find e-books handy?

She dey find am very handy wen she dey travel.

  • Wetin she fit order at any time?

Machi fit order any book wey she want at any time.

  • Shey her husband Goke prefer e-book or normal book?

He prefer to dey hold book for hand.

  • How much time Goke dey spend for bookstore and library?

He dey spend too much time for library and bookstore.

Wen Goke fit buy book?

E fit buy book after e don check.

  • Wetin I prefer to do for bookstore and library?

You prefer to just write di name of book wey you like.

Start the discussion at community.naija.guru

Scroll to Top