Anita and ha mama come my house for morning
Ha mama talk sey I don bring dem shame
Sey hu go take care of pikin wey no get name
Sey haw I go give person belle run
But wetin I go do?
My name na Celeste
But dem no fit see my type for heaven
No be good feeling
Wen yu disappoint plenty people
Oh Celeste, “yu be devil!”
Na wetin Anita talk wen I return
Haw I go leave am with pikin wey we born?
Na condition make me go
But I don come back, and I go follow dem siddon
I go follow train di pikin
My name na Celeste
I don do bad
I no like my past
But na only future I go fit change last-last
Author: Itseme Akede
Start the discussion at community.naija.guru