Dem don nab me

Madam Gold na wicked persin. Any time wey any of us sight am like dis, we dey pick race. Persin no go tell us before we go disappear. All di people wey dey here no get mama and papa. Na Madam Gold be awa mama and papa. She no be better persin, but na im dey give us chow make belle soft, and na im dey give us cloth. No be better gwanj, but last-last we see food chop.

Last week, Madam Gold beat shege komot for one boy bodi. If yu take eye see di boy, na red mark cover im bodi like persin wey tiff for market. Wetin e do? I no dey der but dem talk sey Madam Gold send am go market. Na so di boy go. Wen e reach, dem no give am change. Madam Gold talk sey di boy tiff im money. Dis boy wey I dey look no even sabi two plus two, haw dat one go tiff from Madam Gold?

No be better work Madam Gold dey give us do. Na work wey she no fit ever give ha own pikin do. Time dey wey she go tell us make we gather plastic for dump. Di money wey we make, na she go keep am, like sey na she do di work. If we no find plastic, she go lock us for outside, sey make we sleep for ground. E no go better for am!

Everybodi dey fear Madam Gold. But me? Lai-lai! Na stand my mama take use born me. We don dey plan haw we go take show am pepper, but e be like sey di woman chop winch. Awa plan no dey ever work. But dis time, I really mean am sey I go show am sey I no dey for ha wahala. I begin dey gather spit for cup. Everybodi for yard spit for inside di cup. Dem no even ask me wetin I wan use am do.

Madam Gold dey cook ha food separate normal-normal. She talk sey she no fit chop di yeye tin-dem wey we dey chop. I sabi wer she dey cook ha own. Today, she go chop wetin pass am. I see as she dey cook stew. I no sabi wer she go but I dey try rush. As I dey use one eye look back, I dey use di oda one put di spit for ha stew. As I start to dey turn am, na im I hear persin cough for my back. I no need look back to see sey na Madam Gold.

Hu do me like dis?!

Writer: Itseme Akede; Illustrator: Oritseshemaye Onakpoya

Notable Replies

  1. Wetin una tink about dis stori?

Continue the discussion at community.naija.guru

Participants

Avatar for system Avatar for oga

Scroll to Top