Dem don nab me

Madam Gold na wicked person. Any time wey any of us sight am like dis, we dey pick race. Person no go tell us before we go disappear. All di people wey déy here no get mama and papa. Na Madam Gold be awa mama and papa. She no be better person, but na im dey give us chow mek belle soft, and na im dey give us cloth. No be better gwanj, but last-last we see food chop.

Last week, Madam Gold beat shege komot for one boy body. If yu take eye see di boy, na red mark cover im body like person wey thieve for market. Wetin e do? I no déy der but dem talk sey Madam Gold send am go market. Na so di boy go. Wen e reach, dem no give am change. Madam Gold talk sey di boy thieve im money. Dis boy wey I dey look no even sabi two plus two, haw dat one go thieve from Madam Gold?

No be better work Madam Gold dey give us do. Na work wey she no fit ever give ha own pikin do. Time déy wey she go tell us mek we gather plastic for dump. Di money wey we make, na she go keep am, like sey na she do di work. If we no find plastic, she go lock us for outside, sey mek we sleep for ground. E no go better for am!

Everybody dey fear Madam Gold. But me? Lai-lai! Na stand my mama take use born me. We don dey plan haw we go take show am pepper, but e be like sey di woman chop winch. Awa plan no dey ever work. But dis time, I really mean am sey I go show am sey I no dey for ha wahala. I begin dey gather spit for cup. Everybody for yard spit for inside di cup. Dem no even ask me wetin I want use am do.

Madam Gold dey cook ha food separate normal-normal. She talk sey she no fit chop di yeye thing-dem wey we dey chop. I sabi wer she dey cook ha own. Today, she go chop wetin pass am. I see as she dey cook stew. I no sabi wer she gó but I dey try rush. As I dey use one eye look back, I dey use di oda one put di spit for ha stew. As I start to dey turn am, na im I hear person cough for my back. I no need look back to see sey na Madam Gold.

Hu do me like dis?!

Writer: Itseme Akede; Illustrator: Oritseshemaye Onakpoya

Notable Replies

  1. Wetin una think about dis story?

Continue the discussion at community.naija.guru

Participants

Avatar for system Avatar for oga

Scroll to Top