She get date wit Somto.
E talk “Hello!” and Kemi talk “Hi!”.
Somto siddon, and Kemi look am.
Kemi smile, and Somto dey look am.
“Yu get nice smile”, Somto kon talk.
Na di same story for different way be dis:
I get date wit Somto.
I no sabi Somto.
But na padi of anoda padi.
E reach der on time.
E talk “Hello!” and I talk “Hi!”.
E siddon and I dey look am.
I reason sey e too fine.
I smile, and Somto dey look me.
“Yu get nice smile”, Somto kon talk.
Questions:
- Shey Kemi dey house?
No, Kemi no dey house.
She dey restaurant.
- Shey Kemi get date wit Gbolahan?
No, Kemi no get date wit Gbolahan.
She get date wit Somto.
- Shey Kemi sabi Somto?
No, Kemi no sabi Somto, but na padi of anoda padi.
- Shey Somto reach di restaurant on time?
Yes, Somto reach di restaurant on time.
- Shey Somto talk “Hello?”
Yes, Somto talk Hello to Kemi.
- Shey Kemi reason sey Somto dey fine?
Yes, Kemi reason sey Somto too fine.
- Shey Somto dey look Kemi?
Yes, Somto dey look Kemi.
- Shey Somto talk sey e like Kemi smile?
Yes, Somto talk sey she get nice smile.
Start di discussion for community.naija.guru