Collection of topics on haw Naija Pidgin grammar dey work, wey we explain with simple language.
-
Di verb “to be” for Naija Pidgin
As e be with most languages, di verb “to be” na one of di most common and flexible verbs for Naija Pidgin. Dis article go break down di different forms and functions of “to be”, and e go give yu examples wey go make yu sabi am well-well. Read more
-
Elision for Naija Pidgin
E get several things wey dey make spoken Naija Pidgin difficult to comprehend for person wey neva train im ear. Variation in pronunciation (accents) déy. Variation in style and choice of words (register) déy. Code switching déy plenty. Elision, wey we go discuss for dis article, déy too. Elision na… Read more
-
Haw to write Naija Pidgin
Awa mission for Naija Guru na to facilitate di transformation of Naija Pidgin from vernacular to full-fledge and robust literary language. To achieve dis mission, we need standard way to write di language. Even though several people don attempt to develop orthography for Naija Pidgin, none of dese attempts don… Read more
-
Modal verbs for Naija Pidgin
Modal verbs na verbs wey dem dey use before main verb to show ability, possibility, permission, necessity etc. Dem be modifiers wey dey alter di meaning of di main verb. For dis article, we go itemize di modal verbs wey déy for Naija Pidgin, and we go explain haw dem… Read more
-
Moods for Naija Pidgin
Grammatical mood na di way wey we dey inflect verb to express intent. Di intent fit be to make request, give command, offer suggestion, state fact, or express something wey dey imaginary or hypothetical. Dis article go explain haw verb moods dey work for Naija Pidgin. Read more
-
Negation for Naija Pidgin
We dey use negation to show sey something no true, sey we no want do am, sey e no dey happen, or sey e no fit happen. As with most languages, Naija Pidgin get markers wey we dey use indicate negation, and we get rules for haw we suppose use… Read more
-
Plurals for Naija Pidgin
Plural na di kind word wey we dey use show sey more dan one thing dey. For Naija Pidgin, we dey use all di ways wey e get to take form plural for English. But e get oda ways to run am. Read more
-
Tenses and Conjugation for Naija Pidgin
Tense na di form of verb wey dey tell us wen, and haw long something wey happen happen. For dis article, we go show yu haw we dey form tenses for Naija Pidgin, kon join am with haw we dey conjugate verbs for dese tenses. Read more
-
Understand reduplication for Naija Pidgin
Reduplication na process to take form word, wey be sey we dey repeat all or part of word or phrase to create new word or expression. For Naija Pidgin, reduplication na common feature of everyday speech and e dey serve various functions. Dis article go explore di different-different types of… Read more
-
Word order for Naija Pidgin
Naija Pidgin dey borrow most of im vocabulary from English (im superstrate language). Im grammar structures and sentence constructions, on di oda hand, dey strongly influenced by indigenous Nigerian languages and di sociocultural context of Nigerian society. For languages, word order dey very important, becos if yu alter di order,… Read more