Collection of topics on haw Naija Pidgin grammar dey work, wey we explain with simple language.

  • Di verb “to be” for Naija Pidgin

    As e dey with most languages, di verb “to be” na one of di most common and flexible verbs for Naija Pidgin. Dis article go break down di different forms and functions of “to be”, and e go give yu examples wey go make yu sabi am well-well. Read more

  • Moods for Naija Pidgin

    Grammatical mood na di way wey we dey inflect verb to express intent. Di intent fit be to make request, give command, offer suggestion, state fact, or express something wey dey imaginary or hypothetical. Dis article go explain haw verb moods dey work for Naija Pidgin. Read more

  • Negation for Naija Pidgin

    We dey use negation to show sey something no true, sey we no want do am, sey e no dey happen, or sey e no fit happen. As with most languages, Naija Pidgin get markers wey we dey use indicate negation, and we get rules for haw we suppose use… Read more

  • Plurals for Naija Pidgin

    Plural na di kind word wey we dey use show sey more dan one thing dey. For Naija Pidgin, we dey use all di ways wey e get to take form plural for English. But e get oda ways to run am. Read more

  • Tenses and Conjugation for Naija Pidgin

    Tense na di form of verb wey dèy tell us wen, and haw long something wey happen happen. For dis article, we go show yu haw we dèy form tenses for Naija Pidgin, kon join am with haw we dèy conjugate verbs for dese tenses. Read more

  • Understand reduplication for Naija Pidgin

    Reduplication na process to take form word, wey be sey we dey repeat all or part of word or phrase to create new word or expression. For Naija Pidgin, reduplication na common feature of everyday speech and e dey serve various functions. Dis article go explore di different-different types of… Read more

  • Word order for Naija Pidgin

    Naija Pidgin dey borrow most of im vocabulary from English (im superstrate language). Im grammar structures and sentence constructions, on di oda hand, dey strongly influenced by indigenous Nigerian languages and di sociocultural context of Nigerian society. For languages, word order dey very important, becos if yu alter di order,… Read more

Scroll to Top