- noun: Word wey dem dey use describe persin wey neva face sapa before becos e get soft life.
- Yu go know sey she be ajebutter from di way she dey yarn.
- Dis food get too much pepper for ajebutter like yu.
Etymology
Na Yoruba and English dis word come from. Di Yoruba word na aje wich yu fit translate as persin wey dey chop, and di English word na butter wey dem dey put on top bread. Di idea of di word be sey, people wey fit afford to put butter on top dia bread get moni.
Synonyms
- Butty
Antonyms
- Ajekpako