- noun: Word wey dem dey use describe person wey grow up for trenches. E mean sey di person sabi street, get sense for hustle, and e don tuff becos of di kind life wey e don see.
- Im na real ajepako. E sabi haw to hustle for street.
- She be ajepako. She no dey fear anything.
Etymology
Na Yoruba dis word come from. Di Yoruba words na aje wich yu fit translate as person wey dey chop and pákó wey mean wood. Di idea be sey, poor people-dem déy strong, and dem don hard sotey dem fit even chop wood.
Antonyms
- Ajebutter