- noun: Word wey dem dey use describe persin wey grow up for trenches. E mean sey di persin sabi street, get sense for hustle, and e don tuff becos of di kain life wey e don see.
- Him na real ajepako. E sabi haw to hustle for street.
- She be ajepako. She no dey fear anytin.
Etymology
Na Yoruba dis word come from. Di Yoruba words na aje wich yu fit translate as persin wey dey chop and pákó wey mean wood. Di idea be sey, poor people-dem dey strong, and dem don hard sotey dem fit even chop wood.
Antonyms
- Ajebutter