- noun: Na talk-talk about person private matter wey oda people dey spread becos sey dem want cause wahala or dem just dey use am take entertain diaself.
- I hear plenty amebo about Chairman.
- She no like amebo at all.
- noun: Na person wey dey always spread yeye gist about oda people.
- Dat man na better amebo.
- Yu be yeye amebo person.
Etymology
Na Urhobo dis word come from. Di Urhobo word na avwebo wey yu fit translate as favorite wife. Dem dey use am describe di favorite wife of king or husband wey sabi all di news and information wey ha husband dey get becos she dey close to am.