gbagam

  1. interjection: Word wey dem dey use show loud or sudden sound, like drumbeat or bell.
    • Dem just dey ring di bell, gbagam! gbagam!! gbagam!!!
    • Di beat of di song just dey sweet me. Na dat gbagam-gbagam side I like pass.
  2. interjection: Word wey dem dey use take emphasize sey sometin don end.
    • As di man talk finish, gbagam!, police just enter come arrest am.
    • Na so di girl life just end gbagam!

Synonyms

  • gbam
Scroll to Top