JAMB question

  1. noun phrase: Na question wey déy difficult or unnecessary.
    • Abeg no dey ask me JAMB question.
    • Yu dey ask if I go chop? Wich kind JAMB question be dat?

Etymology

JAMB na acronym for Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB). Dis na di body wey get responsibility to organize di Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME). Dis exam déy required if person want gain admission to study any undergraduate program for tertiary institutions for Nigeria.

Scroll to Top