- verb: Na to dispose or discard something or put am inside dustbin.
- Di food don spoil. Mek we trowey am.
- Abeg trowey di dirty wey déy outside.
- verb: Na to neglect, ignore or abandon person.
- Di man trowey di pikin with im mama like sey no be im born am.
- She just trowey ha face as she see ha ex for di party.
Etymology
Na from di English phrase throw away wey dis word come from.
Antonyms
- keep
- save