waka

Tone: Low, High

  1. verb: Na to move from one place gó anoda place.
    • I go waká gó market today.
    • I waká reach yor house yesterday, but yu no dey.
  2. verb: Na to use leg gó from one place to anoda place without better reason.
    • Wai yu just dey waká up and down?
    • Dat man just dey waká about since im retire.

Synonyms

  • trek

Tone: High, Low

  1. interjection: Na word wey people dey use insult persin. Dem dey point five fingers for di face of di persin wey dem dey talk to, to take follow di insult.
    • Wáka! E no go better for yu.
    • Di man want cheat me. I tell am “wáka!”

Etymology

Na Hausa dis word come from. Di hausa word na uwarka wey mean yor mama (insult).

Scroll to Top