Dozie déy excited about im winter holiday.
He no need work for two weeks.
But France déy expensive.
And Dozie no sabi speak French.
He decide sey he go stay house, study, save im money.
Na di same story for different way be dis:
I déy excited about my winter holiday.
I get time off dis winter.
I no need work for two weeks.
I want go vacation.
I dey reason wer to gó.
I want gó France.
But France déy expensive.
Di airplane ticket too cost.
And I no sabi speak French.
I decide sey I go stay house, study, save my money.
Questions
One: Dozie déy excited about im winter holiday.
Yes, Dozie déy excited about im winter holiday.
Two: Dozie get time off for winter.
Dozie dey free for winter time?
Yes, Dozie get free time for winter.
Three: Dozie want go vacation.
Shey Dozie want stay house?
No, Dozie no want stay house. He want go vacation.
Four: Dozie no sabi wer to gó.
Shey Dozie sabi wer to gó?
No, Dozie no sabi wer to gó.
Five: Dozie dey reason to gó France for im vacation.
Shey Dozie dey reason gó France?
Yes, Dozie dey reason gó France for im vacation.
Six: France cost.
Shey France cheap?
No, France cost.
Seven: Dozie no sabi speak French.
Dozie sabi speak French?
No, Dozie no sabi speak French.
Eight: Dozier decide sey e go stay home, study French, save money.
Shey Dozie decide sey e go siddon for house study French?
Yes, e decide sey e go siddon for house, study French, save im money.