Dozie dey excited about im winter holiday.
He no need work for two weeks.
But, he no sure wer he go go.
He dey reason to go France.
But France dey expensive.
And Dozie no sabi speak French.
He decide sey he go stay house, study, save im money.
Na di same story for different way be dis:
I dey excited about my winter holiday.
I get time off dis winter.
I no need work for two weeks.
I want go vacation.
I dey reason wer to go.
I want go France.
But France dey expensive.
Di airplane ticket too cost.
And I no sabi speak French.
I decide sey I go stay house, study, save my money.
Questions
One: Dozie dey excited about im winter holiday.
Shey Dozie dey excited?
Yes, Dozie dey excited about im winter holiday.
Two: Dozie get time off for winter.
Dozie dey free for winter time?
Yes, Dozie get free time for winter.
Three: Dozie want go vacation.
Shey Dozie want stay house?
No, Dozie no want stay house. He want go vacation.
Four: Dozie no sabi wer to go.
Shey Dozie sabi wer to go?
No, Dozie no sabi wer to go.
Five: Dozie dey reason to go France for im vacation.
Shey Dozie dey reason go France?
Yes, Dozie dey reason go France for im vacation.
Six: France cost.
Shey France cheap?
No, France cost.
Seven: Dozie no sabi speak French.
Dozie sabi speak French?
No, Dozie no sabi speak French.
Eight: Dozier decide sey e go stay home, study French, save money.
Shey Dozie decide sey e go siddon for house study French?
Yes, e decide sey e go siddon for house, study French, save im money.