She get headache and sore throat.
She kon dey sneeze plenty join.
She decide to gรณ see doctor.
She tell doctor as she dey feel.
Di doctor tell Ekama sey she get cold.
Ekama ask doctor for medicine.
Di doctor talk sey Ekama no need medicine for cold.
Di doctor tell Ekama sey mek she drink water, sleep instead.
Ekama still no strong as she komot doctor place.
Na di same story for anoda way be dis:
I no dey feel fine.
I get headache and sore throat.
I kon dey sneeze plenty join.
I decide to gรณ see doctor.
I tell doctor as I dey feel.
Di doctor tell me sey I get cold.
I ask doctor for medicine.
Di doctor talk sey I no need medicine for cold.
Di doctor tell me sey mek I drink water, sleep instead.
I no still strong as I komot for doctor place.
Questions:
No, she no dey feel fine.
She get headache and sore throat.
- Wetin Ekama don dey do plenty?
She dey sneeze plenty.
She decide to gรณ see doctor.
- Wetin she tell doctor?
She tell doctor as e dey do am.
- Wetin di doctor tell Ekama?
Di doctor tell am sey she get cold.
- Shey doctor talk sey Ekama need medicine?
No, di doctor talk sey she no need medicine for cold.
- Wetin doctor tell Ekama mek she do instead?
Di doctor tell Ekama mek she drink water, sleep instead.
- Shey Ekama kon better wen she komot doctor place?
No, Ekama no still strong wen she komot doctor place.
Start di discussion for community.naija.guru