Lotanna na university student.
But first, e gat write some exams.
Lotanna gat write six exams.
Lotanna gat study plenty for im exams.
Dis weekend sha, Lotanna padi dey do birthday.
Lotanna padi want make e show for di party.
Lotanna want go im padi party.
Last-last, e decide sey e go go im padi party.
E go study for exam after di party.
Na di same story for different way be dis:
I be university student.
But I gats write some exams first.
I been get six exams to write.
I gats study well-well for di exams.
Dis weekend sha, my padi dey do birthday.
My padi want make I come for im party.
I want go my padi party.
Last-last, I decide sey I go go my padi party.
I go study for exam after di party.
Questions:
- Hu be Lotanna?
Lotanna na university student.
- Wen Lotanna dey graduate?
E dey graduate next month.
First, Lotanna get some exams e go need write.
- Shey Lotanna gats write nine exams?
No, Lotanna no need write nine exams.
Na six exams e suppose write.
- Wetin Lotanna padi do for weekend?
Lotanna padi get birthday party dat weekend.
- Wetin Lotanna padi want?
Lotanna padi want make Lotanna come di party dat weekend.
- Shey Lotanna want go di padi party?
Yes, Lotanna want go im padi party.
- Wetin Lotanna kon decide?
Lotanna decide sey e go go im padi party.
- Wich time Lotanna kon study for im exam?
Lotanna study for di exam after di party.
Start di discussion for community.naija.guru