Lotanna na university student.
But first, e gat write some exams.
Lotanna gat write six exams.
Lotanna gat study plenty for im exams.
Dis weekend sha, Lotanna padi dey do birthday.
Lotanna padi want mek e show for di party.
Lotanna want gó im padi party.
Last-last, e decide sey e go gó im padi party.
E go study for exam after di party.
Na di same story for different way be dis:
I be university student.
I dey graduate next month.
But I gat write some exams first.
I get six exams to write.
I gat study well-well for di exams.
Dis weekend sha, my padi dey do birthday.
My padi want mek I come for im party.
I want gó my padi party.
Last-last, I decide sey I go gó my padi party.
I go study for exam after di party.
Questions:
Lotanna na university student.
E dey graduate next month.
First, Lotanna get some exams e go need write.
No, Lotanna no need write nine exams.
- Wetin Lotanna padi dey do for weekend?
Lotanna padi get birthday party for weekend.
- Wetin Lotanna padi want?
Lotanna padi want mek Lotanna come di party.
- Shey Lotanna want gó di padi party?
Yes, Lotanna want gó im padi party.
Lotanna decide sey e go gó im padi party.
Lotanna study for di exam after di party.
Start di discussion for community.naija.guru