25 – New pikin 👶🏽

Debo wife go get new pikin.

Debo and im wife get one son and one daughter.

Dem déy very happy sey dem go get anoda pikin.

Di new pikin na boy.

But dem no sabi wich name to give di pikin.

Dem decide to ask dia maale and paale.

Dia maale and paale give dem some kind ideas.

Some idea better pass di odas.

Debo and im wife go call di pikin Eri’ife.

Dem hope sey di pikin go déy happy with di name.

Na di same story for different way be dis:

My wife dey born new pikin.

Me and my wife get one son and one daughter.

We déy very happy to get anoda pikin.

Di new pikin na boy.

But we no sabi wich name to give di pikin.

We decide to ask awa maale and paale.

Awa maale and paale give us some kind ideas.

Some idea better pass di odas.

Me and my wife go call awa pikin Eri’ife.

We hope sey di pikin go déy happy with di name.

Questions:

  • Wetin Debo wife go get?

Debo wife go born pikin.

  • Haw many pikin Debo and im wife get?

Dem get two pikin – one son and one daughter.

  • Haw dem dey feel sey dem go born anoda pikin?

Dem déy very happy to born anoda pikin.

  • Shey di new pikin na girl?

No, di new pikin no go be girl.

Di new pikin go be boy.

  • Shey dem sabi di name to give di pikin?

No, dem no sabi wich name to give di pikin.

  • Wetin dem kon decide?

Dem decide to ask dia maale and paale dem for name for di pikin.

  • Wetin dia maale and paale kon do?

Dia maale and paale give dem some ideas.

  • Shey all di ideas déy good?

No, no be all di idea déy good.

Some idea better pass di odas.

  • Wetin Debo and im wife call di pikin?

Dem call di pikin Eri’ife.

  • Wetin Debo and di wife dey hope?

Dem hope sey di pikin go déy happy with di name.

Start di discussion for community.naija.guru

Scroll to Top