26 – Ahmed and im room 🧹

Ahmed go clean im room.

E get many things to do.

First, e go put im dirty clothes for one side.

Den e go wash di clothes for washing machine.

E go kon clean under im bed.

E find plenty toys for under im bed.

E go put all im toys for inside wardrobe.

Last-last, e go clean im desk, put im school work for desk.

E think say im mama go happy well-well.

Na di same story for anoda way be dis:

I dey clean my room.

I get many things to do.

First, I put my dirty clothes for one side.

Den I kon wash am for washing machine.

I kon clean under my bed.

I find many toys dem for under di bed.

I put all di toys for inside wardrobe.

Last-last, I clean my desk, put my school work for desk.

I think sey my mama go happy well-well.

Questions:

  • Wetin Ahmed go do?

E go clean im room.

  • Shey e get small things to do?

No, e no get small things to do.

E get many things to do.

  • Wetin e go do first?

First, e go put im dirty cloth for one side.

  • Wetin e go kon do?

E go kon wash im cloth for washing machine.

  • Wetin again Ahmed go do?

Ahmed go also clean under im bed.

  • Wetin Ahmed find for under im bed?

E dey find many toys for under im bed.

  • Where e kon put di toys?

E put all di toys for inside wardrobe.

  • Wetin Ahmed kon do last-last?

Last-last, Ahmed clean im desk, put im school work for dia.

  • Haw Ahmed think sey im mama go feel?

Ahmed think sey im mama go happy well-well.

Start di discussion for community.naija.guru

Scroll to Top