32 – Seyi dey make breakfast for ha family 🍳

Seyi been dey try make breakfast since morning.

Ha pikin and husband don dey wait di breakfast too.

Nothing too dey fridge wen Seyi look inside.

Na just egg, bread and milk.

Last-last, she decide to cook egg.

She put water for fire, kon put three eggs for inside.

She kon make tea for hasef and di husband.

Ha pikin drink orange juice.

Na di same tori for anoda way be dis:

I don dey try make breakfast since morning.

My pikin and my husband don dey wait for di breakfast too.

I look for inside fridge.

But food no too dey.

Na egg, bread and milk I see.

I decide say na egg I go make.

I put water for fire, kon put three eggs for inside.

I kon make tea for myself and my husband.

My pikin go drink orange juice instead.

Questions:

  • Wetin Seyi don dey try make?

Seyi don dey try make breakfast.

  • Wetin Seyi pikin and husband don dey wait for?

Dem don dey wait for di breakfast.

  • Shey plenty food dey inside fridge?

No, food no too dey inside fridge.

  • Wetin Seyi see for inside fridge?

Seyi see eggs, bread and milk for inside fridge.

  • Wetin Seyi decide cook?

Seyi decide to cook egg.

  • Wetin Seyi don dey do?

Seyi don put wata for fire, she don put three eggs for inside.

  • Wetin again Seyi dey make?

Seyi dey make tea for haself and di husband too.

  • Shey Seyi pikin dey drink tea too?

No, Seyi pikin no dey drink tea.

Na orange juice e dey drink.

Start di discussion for community.naija.guru

Scroll to Top