41 – Akin for restaurant 🍽️

Akin dey restaurant wit im padi.

Na dia first time for di restaurant, and dem dey reason wetin to chop.

Akin want order three different kain of chow because e wan try di new-new things wey dey di menu.

But if e go order plenty chow, e go pay more dan im padi.

Hunger no too dey catch Akin padi, so Akin padi order just small chow.

Akin kon decide to get just small-small chow too.

Na di same story for anoda way be dis:

I dey restaurant wit my padi.

Na awa first time for di restaurant, so we dey try decide wetin to chop.

I be wan order three different chow because I wan try all di new tins-dem wey dem get for menu.

But if I go order plenti food, I go need pay more dan my padi.

Hunger no too dey catch my padi, so my padi just order small chow.

I decide sey I go just order small chow too.

Questions:

  • Hu dey restaurant wit Akin?

Akin dey di restaurant wit im padi.

  • Wetin Akin and im padi dey do?

Dem dey decide wetin to chop.

  • Shey hunger dey catch Akin padi?

No, e no dey catch am.

  • Which kain chow Akin padi order?

Akin padi just order small-small chow.

  • Shey Akin and im padi don go di restaurant before?

No, na dia first tiem for dia be dat.

  • How many chow Akin wan order?

Akin wan order three different chow.

  • Wetin for don happen if Akin order plenti chow?

E for need pay more dan im padi.

  • Wetin Akin decide to get?

Akin decide say e go only get small-small chow.

Start di discussion for community.naija.guru

Scroll to Top