43 – Bode and im schedule 📆

Bode dey look im school schedule.

E get very busy schedule.

All im classes na ninety minutes.

And all im weekdays dey full.

E no get much free time for evening, and e no get any free time for Mondays.

E no get class for weekends sha, so e fit see small time see im padis.

Even dou e get small time for imsef, most of di time e go dey study.

Na di same story for anoda way be dis:

I dey look my school schedule.

I get very busy schedule.

All my classes na ninety minutes.

And all my weekdays don full.

I no too get free time for weekends, and I no get any free time for Mondays.

I no get any class for weekends sha, so I go fit see small time to see my padis.

Questions:

  • Wetin Bode dey look?

Bode dey look im school schedule.

  • Haw long be im classes?

All im class na for ninety minutes.

  • Haw much free time Bode get for evenings?

Bode no too get free time for evenings.

  • Shey Bode get class for weekends?

No, Bode no get class for weekends.

  • How busy Bode Schedule be?

Im schedule dey very busy.

  • How many weekdays Bode get wey full?

All of Bode weekday dey full.

  • How much free time Bode get for Mondays?

Bode no get any free time for Monday.

  • Shey Bode get time see im padis?

Yes, Bode get small time to see im padis.

Start di discussion for community.naija.guru

Scroll to Top