Moyo dey live alone for small apartment.
E gat do all di housework alone.
But e too dey work, so e no dey ever get time to clean.
Im clothes and plates déy always dirty.
E dey try dress up for work.
But e no get any clean socks.
Na only small time e get before work start.
E realize sey if e gó shop before work start, e fit buy new socks.
Last-last, e decide to wash all im clothes after work.
Na di same story for anoda way be dis:
I dey live alone for small apartment.
I gat do all di housework alone.
But I too dey work, so I no dey ever get time to clean.
My clothes and plates déy always dirty.
I dey try dress up for work.
But I no get any clean socks.
Na small time I get before work start.
I realize sey if I gó shop before work start, I fit buy new socks.
Last-last, I decide sey I go try wash my clothes after work.
Questions:
No, Moyo no dey live with anybody.
E dey live alone for small apartment.
- Shey Moyo dey get time clean?
No, Moyo no dey ever get time to clean.
Moyo dey try dress up for work.
Na only small time e get before work start.
Moyo gat do all di housework.
- Wetin dey always dirty?
Moyo clothes and plates dey always dirty.
- Wetin Moyo no get?
E no get any clean socks to wear gó work.
Moyo reason to gó shop before work start.
Start di discussion for community.naija.guru