45 – Tonye don dey hike 🥾

Tonye don dey hike for mountain for three days.

He don stop to look im map.

E suppose dey gó West, but e no dey understand anything wey déy di map.

If na West e dey gó, e suppose don see lake by now.

E dey reason sey na North e don dey gó instead.

E for like use im phone to check map, but di hiking brochure talk sey network no go déy di mountain.

Tonye decide sey e go set up camp for di night.

Maybe after e sleep finish, e go fit figure am out di next day.

Na di same story for anoda way be dis:

I don dey hike for mountain for three days wen I stop look my map.

I suppose dey gó West, but I no understand anything for di map.

If na West I dey gó, I suppose don see lake by now.

I dey reason sey na North I don dey gó instead.

I for like use my map for phone, but di hiking brochure talk sey network no go déy di mountain.

I decide sey I go set camp for tonight.

Maybe wen I don sleep finish, I go fit figure am out tomorrow.

Questions:

  • Haw long Tonye don dey hike?

Tonye don dey hike for mountain for three days.

  • Wai e need stop?

He gat stop so e fit check im map.

  • Wich way e suppose dey gó?

E suppose dey gó West.

  • Wetin suppose don happen if e dey gó West?

E suppose don see lake if e dey gó West.

  • Wich direction e reason sey e don dey gó?

E reason sey e don dey gó North instead.

  • Wai e no fit use im phone map?

Becos di hiking brochure talk sey no network go déy for di mountain.

  • Wetin e decide do?

E decide sey e go set camp for di night.

  • If e sleep, wich time e go fit figure am out?

If e sleep finish, e go fit figure am out for morning.

Start di discussion for community.naija.guru

Scroll to Top