45 – Tonye don dey hike 🥾

Tonye don dey hike for mountain for three days.

He don stop to look im map.

E suppose dey go West, but e no dey understand anything wey dey di map.

If na West e dey go, e suppose don see lake by now.

E think sey na North e don dey go instead.

E for like use im phone to check map, but di hiking paper talk say network no go dey di mountain.

Tonye decide sey e go set up camp for di night.

Maybe after e don sleep finish, e go fit figure am out tomorrow.

Na di same tori for anoda way be dis:

I don dey hike for mountain for three days when I stop look my map.

I suppose dey go West, but I no understand anything for map.

If na West I dey go, I suppose don see lake by den.

I tink say na North I don dey go instead.

I for like use my map for phone, but di hiking brochure talk say network no dey di mountain.

I decide set camp for tonight.

I dey tink say wen I don sleep finish, I go fit figure am out di next day.

Questions:

  • Haw long Tonye don dey hike?

Tonye don dey hike for mountain for three days.

  • Why e need stop?

He gats stop so e fit check im map.

  • Which way e suppose dey go?

E suppose dey go West.

  • Wetin suppose don happen if e dey go West?

E suppose don see lake if e dey go West.

  • Which direction e tink say e dey go?

E tink say e don dey go North instead.

  • Why e no fit use im phone map?

Because di hiking brochure talk say no network go dey for di mountain.

  • Wetin e decide do?

E decide to set camp for di night.

  • If e sleep, which time e go fit figure am out?

If e sleep finish, e go fit figure am out for morning.

Start di discussion for community.naija.guru

Scroll to Top