Jola just start new work.
She don dey enjoy di work well-well, but she dey get some kain wahala wit ha oga.
Wen dem get meeting, if she try talk, ha oga no go gree am talk.
She wish sey e go give am chance to talk, and she for like am if e care about ha opinion.
She hope sey she go fit solve di wahala.
She fit look for new work, but last-last, she think sey e go better if she stay for dis one.
Na di same story for anoda way be dis:
I start new work last year.
At first, I dey enjoy di work well-well, but I dey get some kain wahala wit my oga.
For meetings, if I try talk, my oga no go gree me talk.
I wish sey e fit give me chance talk, and I for like am if e care about my opinion.
I hope sey I go fit solve dis wahala.
I fit go look for new work, but I tink say last-last. e go better if I stay for dis one.
Questions:
Jola start new work.
- She dey enjoy di work?
Yes, she don dey enjoy di work well-well.
- Hu she don dey get wahala wit?
She dey get wahala wit ha oga.
- Wetin dey happen for meetings?
For meeting, if she try talk, ha oga no go gree am talk.
- Wetin she wish?
She wish sey e go give am chance talk.
- Wetin Jola for like?
She for like am if he care about ha opinions.
- Wetin she hope?
She hope sey she fit solve di wahala.
Becos last-last, she tink sey e better to stay for dis one.
Start di discussion for community.naija.guru