51 – New phone 📱

Kelechi don dey find new phone.

E don check plenty shops for di area wey e dey live, but e no fit find anything wey no cost.

Kelechi decide to look online instead.

Even though e no really rust online shopping, e dey hope sey di tins for online go dey cheap.

After e don search tey-tey, Kelechi find phone wey e like.

Na like half di price of di oda ones, so e buy am.

E dey hope sey e go last long.

Na di same story for anoda way be dis:

My son don dey find new phone.

E don check plenty shops for di area wey we dey live, but e neva still see di one wey no too cost.

E decide to look online instead.

Even though e no too trust online shopping, he dey hope sey online shop no go too cost.

After e don search tey-tey, e find phone wey e like.

Na like half di price of di oda ones, so e buy am.

I hope sey e go last long.

Questions:

  • Wetin Kelechi don dey find?

Kelechi don dey find new phone.

  • Wer e don look?

E don look for many shops for di area wer e dey live.

  • Shey e don find one wey no too cost?

No, e neva still find one wey no cost.

  • Wer Kelechi don decide to check?

Kelechi don decide to look online instead.

  • Shey e trust online shopping?

No, e no too trust online shopping.

  • Haw long e dey search online?

E search for few hours. E find phone wey no cost after e don search tey-tey.

  • Wai e buy am?

Becos na like half di price of oda ones.

  • Wetin e hope sey no go happen?

He hope sey e no go break easily.

Start di discussion for community.naija.guru

Scroll to Top