56 – Mariam make business decision 👩🏽‍💼

Mariam na oga of marketing for one manufacturing company.

She dey convinced say now na di best time for her company to expand go obodoyinbo since demand dey grow for di company products for foreign markets.

No be only sey exports dey grow, but very good part suppliers dey for some countries for obodoyinbo.

So expanding go obodoyinbo go increase market share and reduce cost too.

Any move go obodoyinbo go require careful planning.

Since conditions for all di obodoyinbo dey different, she go need find pipu wey sabi dat tin well-well to help am.

Mariam don visit most of di important markets for obodoyinbo.

She no want mess up, so she decide to ask her customers wey she get before for obodoyinbo for advice.

E go take time for am to do di necessary research to make sure say di expansion plan dey successful.

Na di same tori for anoda way be dis:

I be oga for marketing for one manufacturing company before before.

I dey convinced say na time for awa company to expand go obodoyinbo since demand begin dey grow for awa products for obodoyinbo market.

No be only say exports dey grow, but very good parts suppliers dey for some parts of obodoyinbo.

So expanding go obodoyinbo go increase market share and reduce cost too.

Any move go obodoyinbo go require careful planning.

Since conditions for all di obodoyinbo dey different, I sabi say I go need find pipu wey sabi dat tin well-well to help me.

I don visit most of di important markets for obodoyinbo.

I no wan mess up, so I decide to ask my customers wey I don get before for obodoyinbo for advice.

E go take time for me to do di necessary research to make sure say di expansion plan dey successful.

Questions:

  • Wetin be Mariam work?

Mariam work na oga of marketing for one manufacturing company.

  • Wetin Mariam dey convinced about?

She dey convinced say now na di best time for her company to expand go obodoyinbo.

  • Where veri good parts suppliers dey?

Vei good parts suppliers dey some countries for obodoyinbo.

  • Wetin expanding go obodoyinbo go do?

Expanding go obodoyinbo go increase market share and reduce cost also.

  • Who I sabi wey I fit find who go fit help me?

You sabi say you go need find pipu wit local expertise.

  • Shey I don visit all di important obodoyinbo markets?

No, you don visit most of di obodoyinbo market.

  • Wetin I ask my customers for obodoyinbo wey I don get before?

You ask dem for advice.

  • Shey e go take me short time to do di necessary research?

No, e go take you long while to do di research.

Start di discussion for community.naija.guru

Scroll to Top