Banji hate to dey stuck for go-slow, especially wen e dey go work abi e dey come back.
He tink say one way to reduce go-slow na to share car wit persin since dat one go mean less moto for road.
To dey share moto start some decades ago, but most pipu no like am because dem like dia privacy as dem dey drive.
Some pipu dey also reason haw safe e be to dey car wey stranger dey drive.
For some cities, dem get special lane for highway for pipu wey dey share moto.
Only moto wey get 2,3 or more pipu fit drive for di lanes.
To share motor fit help yu reach work faster, but e require sey make pipu change some of dia habits.
For di last few years, to dey share moto don grow, becos go-slow don dey worse.
To share moto dey save pipu time and money, but di koko be say e dey good for environment.
Na di same story for anoda way be dis:
Before, I hate to dey for go-slow wen I dey go work and wen I dey come back.
I tink say one way we go fit reduce go-slow na to share moto wit person since dat one go mean less moto for road.
To dey share moto start some decades ago, but most pipu no like am because dem like dia privacy as dem dey drive.
I kon dey concerned about if e dey safe to dey travel for moto wey stranger dey drive.
For some cities, dem don already get special lane for pipu wey dey share moto for highway.
I like am.
To dey share moto dey help me reach work faster,
Questions:
- Which time Banji dey hate go-slow?
E dey hate go-slow wen he dey go work and wen e dey come back.
- Na which way Banji tink say go-slow fit reduce?
E tink say one way wey go-slow fit reduce na to share motor wit anoda persin.
- Shey to share motor go mean less motor or more motor for road?
To share motor go mean less motor for road.
- Shey to share motor start last year?
No, to share motor start few decades ago.
- Haw I feel say make stranger dey drive me?
You dey feel concerned to dey motor wey stranger dey drive.
Some cities don get lane for road wey na for only those wey dey share motor.
- Haw many pipu suppose dey di motor wey dey use dat lane?
Motor wey dey drive for dat lane gats get two, three or four pipu.
- Why to share motor don grow in di last few years?
E don grow because traffic don dey get worse.
Start di discussion for community.naija.guru