58 – Soji and Bola like to dey komot πŸ‘¨πŸ½β€πŸ€β€πŸ‘©πŸΎ

Soji and Bola like to dey komot wit dia padis.

Dem dey enjoy one or two glasses of wine wit dia chow wen dem komot.

Because of dat, e dey important say dem tink haw dem go reach house after dinner.

Dem dey usually drive dia moto go di restaurant, or go dia padi house, because to take taxi too cost.

Dem dey decide before time on who go drive go house, since di persin wey drive no fit drink wine.

Sometimes, dem sabi say e go dey hard not to drink wit oda pipu, like wen padis dey do birthday.

For dat one, dem go need make oda arrangements.

One solution na to go wit dia padis wey dey live around, and one of dem go gree say im no go drink.

E dey useful to get padis wey no dey drink at all.

Na those pipu we dey always like make dem be designated drivers.

Di best situation na wen di dinner party na where dem fit trek go.

Unfortunately, dis no be di case for big-big cities.

Na di same tori for anoda way be dis:

We dey enjoy komot go dinner wit awa padi wen we still dey live for big city.

We dey enjoy one or two glasses of wine wit awa chow wen we dey komot.

Becos of dat, we gats think about haw we go reach house after.

We dey usually drive go di restaurant, or to awa padi house because e too cost to take taxi.

We dey always decide before time who go drive us go house, since di persin wey drive no go fit drink wine.

Sometimes we sabi say e go dey difficult make persin no drink wit oda pipu dem, if padis dey celebrate event like birthday.

For dat one, we gatts make oda arrangements.

One solution na to go wit oda padis wey no dey live far, one of dem wey no go drink.

E good to get padi wey no dey drink at all.

Na dem we dey always use take do designated driver.

Di best situation na when di parti dey where we fit walk go.

Unfortunately, dis no be di case for big city. So we kon move go small city and now we dey spend time with awa neighbours.

Questions:

  • Haw many glasses of wine dem dey enjoy wit dia chow wen dem dey komot?

Dem dey enjoy one or two glasses of wine wit dia chow wen dem komot.

  • Wetin dey important for dem to tink about?

E dey important for dem to tink about haw dem go reach house after dinner.

  • Why dem no use taxi?

Because e too cost to use taxi.

  • Wetin dem dey decide before time?

Dem dey decide before time who go drive gol house.

  • Shey we think say e go dey easy or e go hard not to drink wit oda pipu dem?

You sabi say e go dey difficult make you say no to drink wit oda pipu.

  • Wetin we gats do for dat situation?

You need make oda arrangement for those situations.

  • Which kain padis I dey find useful make we get?

You find am useful to get padis wey no dey drink.

  • Why those kain pipu dey in demand?

Because na dem we dey always use as designated driver.

Start di discussion for community.naija.guru

Scroll to Top