Ade get new babe.
Im babe name na Sola.
Ade want make dinner for Sola.
Ade carry basket.
He waka pass di vegetable section.
He look di fish wey dey freezer.
He stand near di salad counter.
Ade go house go order pizza.
Na di same story for different way be dis:
I get new girlfriend.
Ha name na Sola.
I want make dinner for Sola.
I go grocery store.
I carry basket.
I waka pass di vegetable section.
I look di fish wey dey freezer.
I stand near di salad counter.
Last-last, I komot di store.
I go house go order pizza.
Questions:
- Shey Ade get new girlfriend?
Yes, Ade get new girlfriend.
Her name na Sola.
- Shey Ade wan make lunch for Sola?
No, Ade no wan make lunch for Sola.
- Shey Ade go grocery store?
Yes, Ade go grocery store go buy food.
- Shey Ade buy vegetables?
No, Ade no buy vegetables.
He waka pass di vegetable section.
- Shey Ade look di fish?
Yes, Ade look di fish but e no buy am.
- Shey Ade stay for di store?
No, Ade komot di store las-las go house.
- Shey Ade make dinner?
No, Ade no make dinner.
He go order pizza.
Start di discussion for community.naija.guru