10 – Birthday party 🎂

Jide dey gó birthday party.

E go need buy present for Moyin.

Jide no too dey gó party sha.

E déy nervous and e no sabi wetin to buy.

Moyin like jewelry, animals and color blue.

Jide gó jewelry store.

E see one fine, silver necklace.

Di necklace get blue cat on top.

Jide déy happy, and e buy di necklace.

E hope sey Moyin go like di necklace.

Na di same story for different way be dis:

I dey gó birthday party.

I go need buy birthday present for Moyin.

I no too dey gó party sha.

I déy nervous and I no sabi wetin to buy.

Moyin dey like jewellery, animals and colour blue.

I gó jewelry store.

I see one fine silver necklace.

Di necklace get blue cat on top.

I déy happy, and I buy di necklace.

I hope sey Moyin go like di necklace.

Questions:

  • Shey Jide dey gó birthday party?

Yes, Jide dey gó Moyin birthday party.

  • Shey Jide dey gó plenty party?

No, Jide no too dey gó party, so e déy nervous.

  • Shey Moyin like animals?

Yes, Moyin like animals. She kon like color blue join.

  • Shey na Moyin gó jewelry store?

No, Moyin no gó jewellery store. Na Jide gó.

  • Shey Jide see silver ring?

No, e see silver necklace. No be ring.

  • Di necklace na silver or gold?

Di necklace na silver. No be gold.

  • Purple cat déy di necklace?

No, e no déy. Na blue cat déy di necklace.

  • Shey Jide buy di necklace?

Yes, Jide buy di necklace becos e reason sey Moyin go like am.

Start di discussion for community.naija.guru

Scroll to Top