10 – Birthday party 🎂

Jide dey go birthday party.

E go need buy present for Moyin.

Jide no too dey go party sha.

E dey nervous and e no sabi wetin to buy.

Moyin like jewelry, animals and color blue.

Jide go jewelry store.

E see one fine, silver necklace.

Di necklace get blue cat on am.

Jide dey happy, and e buy di necklace.

E hope say Moyin go like di necklace.

Na di same story for different way be dis:

I dey go birthday party.

I go need buy birthday present for Moyin.

I no too dey go party sha.

I dey nervous and I no sabi wetin to buy.

Moyin dey like jewellery, animals and colour blue.

I go jewelry store.

I see one fine silver necklace.

Di necklace get blue cat for am.

I dey happy, and I buy di necklace.

I hope sey Moyin go like di necklace.

Questions:

  • Shey Jide dey go birthday party?

Yes, Jide dey go Moyin birthday party.

  • Shey Jide dey go many party?

No, Jide no too dey go party, so e dey nervous.

  • Shey Moyin like animals?

Yes, Moyin like animals. She kon like color blue join.

  • Shey na Moyin go jewelry store?

No, Moyin no go jewellery store. Na Jide go.

  • Shey Jide see silver ring?

No, e see silver necklace, no be ring.

  • Di necklace na silver or gold?

Di necklace na silver, no be gold.

  • Purple cat dey di necklace?

No, e no dey.

Na blue cat dey di necklace.

  • Shey Jide buy di necklace?

Yes, Jide buy di necklace because e reason sey Moyin go like am.

Start di discussion for community.naija.guru

Scroll to Top